CHILD MOLESTATION…….My Ranting

This is something I have always wanted to talk or write on so I’m just gonna write (as I no get where to talk. lol). I’ve been itching to write a post in pidgin so I’m gonna do it now. My oral pidgin is not veryyyyy sound so I’m hoping the written one would be near perfect :D. I wanna add that I’m gonna be using some ‘crazy’ terms so please manage and understand. lol

Country pipo, today I wan write about Child molestation. I know say molestation na big word so I go try explain am. Na when big man or woman dey touch touch small, small children for places when them no suppose to dey touch. Another thing for the mata be say, any pikin wey neva rish that kain 18 years na small pikin o. E get the one when them dey call child abuse. Child abuse na the same thing with child molestation o. Infact, that thing when dem dey call google wen know everything help us explain am wella. Them say na when u ask or force pikin to do chukili things, when u dey show pikin dem ur booby,plus ur wee-wee and your chomchomchom. E fit be wen dem use pikins take dey act blue fim too. The thing wey dey disturb me for the mata na why dem dey do all those kain things? Some people dey even beat these chidren dem so that dem no go report them.

Now when I don try define am small, make I talk about am and why e dey vex me. Whenever I hear say sonthing like molestation happen I dey always dey wonder wetin push the person. Most of the times we dey hear say na the man be the adult wey go dey molest small girls. How man of 40 something years go dey finger small girl of 5years????? Wetin the girl get when dey raise im body? Abi na the house girl when go carry im madam pikin dey force the pikin make im suck her booby and touch her chomchomchom? Shey dem dey think say the pikin no go know wetin dem dey do? I been dey watch one video on top internet wey one small girl wen suppose to dey baf one small boy been dey follow am do things wey me sef, fear go catch me before I do am! The only thing wey I talk be say that girl go don dey learn those things from one broda or sista for one place.

This child molestation dey happen for places wen u no go expect sef. e dey happen for house, for school, inside bus and even for church. No even look me say e no dey happen for bus o! Person don throway for my cousin body for inside bus for Abuja. She fit talk abt am because she big. If na small pikin, she for no know wetin the yeye man dey do. Some kain pastor go say make people bring dem smallie come for deliverance, next thing them go dey do another thing. For skool na constant-K! That one nai common pass sef. All dose copas wen dey go skool go molest small small shidren….God dey watch una o. Mok una remember say wetin u do pesin nai dem go do you.

I want make we settle down gist the one wey dey happen for house. No be the one wey house help dey do with chidren o. No be the one when oga dey do with small housegirl o. Na the one wen oga dey do with im own pikin dem. No be say na only papa dey do am o but I neva hear say dem say mama dey molest im pikin. So we go talk abt the papa dem wen dey do am. Oyibo man dey call am incest. I neva still understand why pesin go dey trip for im own pikin, especially when the pikin still be omormor. Wetin do dia mama wen dey for house? That thing na serious tufiakwa!!! Dat kain man deserve make them roast am till I’m kpeme.

The touch touch wey dem dey do those shidren dey usually dey affect well well. Some of them, infact shingeli no dey remember wetin happen when dem big. Those na the ones wey dem quick stop to touch o. The ones wey dem touch tey nai dey get plenty wahala. Some go dey shame anyhow like say na dia fault, some go dey like to dey sleep with man everytime. Dia chomchomchom go dey scratch them everytime. Na that kain konji dem dey call nymphomania. Some of dem dey even old come dey act blue fim or just become ashawo kpa kpa. The ones wey dey keep to diasef because dem dey shame nai plenty pass. Depression go dey worry dem anyhow. Some dey even dey get belle! Some dey carry yama yama disease sef 😦

I dey always dey wonder wetin dey the mind of the people wen dey do all these things? Women plenty for the world when those men fit gist start to friend na. If na to carry ashewo, dat one sef cheap. I hear say na 500 for half-time abi na term. Just make sure say no be under-age u go carry in the name of ashewo. Even sef, you fit make your sef ‘hand-some’ as we dey talk am for obodo twitter. Use ur hand! Afterall, one pasitor say no be sin and that way you no go dey spoil person life.

All these plenty yarn wen I don drop nova still talk why people dey do am o….u notice am abi? That na because say I no know why! Them dey always say na ‘devo handwork’ when them catch them. You dey see the yeye fawos???

Abeg, make una help me comment on top this matter. Make e no be like say I too dey talk. If you know some of the reasons when make dem dey do am….abeg, make we follow know some of them. If u think say na nonsense I right, abeg follow use the commentator box 😀 …… May God save our pikin dem from molesters o. Una do well wen una take read my plenty plenty talk o. My mind dey jolificate dey drink zobo :*

Sexually Abused child.
Sexually Abused child. (Photo credit: Wikipedia)

About shughar

My name is Patrick Jennifer.............. Talkative extraordinaire (aspiring OAP), Professional 'carer', Wanna-be writer, and I am sweetness personified.
This entry was posted in Uncategorized. Bookmark the permalink.

51 Responses to CHILD MOLESTATION…….My Ranting

  1. Jojo says:

    Na wa. World don spoil truetrue. I no fit imagine wetin they carry these thoughts into thee mind of these adults. May Godd help us all. Amen.

    Like

  2. efua says:

    ..D mata dey tire me too anytime wey I hear am. D tin wey dey pain me be say, dem go use their korokoro eye do am nd wen dem catch dem, dem go start to de blame devil…as u talk so ehn, I wan sti1ll find out wetin de worry dem. If u know d ansa, nr forget to tell mew.

    Like

  3. Tchyd says:

    Let me use pidgin too like my ore. No laff sha o. Me sef tire 4 the matter o. I still dey wonder too o, wen plenty gals dey nyafu nyafu,which kind satisfaction dm want get frm small chinkili pikin abeg? I no no any reason sha o,bt the common thing wey dm dey talk na devil,it ws the devil’s work. Nonsense.. Mtcheew. Mk God save our family n friends.

    Like

    • shughar says:

      Lol.d thing dey tire me steadily.Ami ooooo….. God know say I fit kill pesin if I catch person with my pikin sha.

      Like

      • Tchyd says:

        Na the punishment wey u talk na him swt pass 4 those kind pipu,roast am like yam. U knw say roasted yam no dey done quick,e go jst dey burn small small dey die dey go. All the injuries wey e substain frm beating plus d hair for I’m body go jst dey roast dey smell like goat meat. Chei!!! Lol.. I no wicked o,bt na wetin gd 4 dm b dat. Nxt tym odas go learn hold body. Thief evn better pass dis kind pipi u knw ba?

        Like

      • shughar says:

        This tchyd too sabi….dem s’pose start d roasting from dia wee-wee and chomchomchom sef.tif na dem small broda na.dose one levos no rish dis yeye touchi touchi pipo!

        Like

  4. mentoriser says:

    U try wella, ur flow dey make my somtin dey rise..even as I show dis write-up to my real kpogris dem say u pilay d matter cofam! U bold like spare tire..tuale !!!

    Like

    • shughar says:

      Mentor!thank God say I no be sumol pikin.I for don dey look u with one kain eye.lol
      Thank u for your confirmentation.help me tell ur kpogris say dem too bam.una do well 🙂

      Like

  5. Genro says:

    This your pidgin makes it sound so interesting and on point. It should not be as if am forming but this topic wey you disect here na very serious one, me I feel say na one of those yamayama cultural believe dey make some they act like that to girls. Make I no sha catch one, he or she go need explain when he/she and devil do meeting before the thing happen…..

    Like

    • shughar says:

      Laf wan kill me o.abeg,I go like know when dem do the meeting too o.I sabi one of the cultural beliefs when you dey talk.if na the ones when dey marry them,na different case.if e pass that one,den the matter don critical oooooo

      Like

    • richvic. says:

      I dey hail d house o.my own contribute na sey !.d tin bad well.well
      .but some of dis tins dey happen bcos of lack of control.as a humanbeing e no easy to control urself but selfcontrol makes u to avoid some certain incidents.

      Like

      • shughar says:

        Hmmmm.u talk true my brother,thank u.e be like say God for help us dey make self-control wen dem fit dey buy for market.afterall,common sense no common.

        Like

  6. Jess' says:

    Nice write-up.. Keep it up.. Say no to child molestation! 😐

    Like

  7. frankie says:

    Well the thing wey I see inside be say, these men get psychological problem na dat one oyinbo go say(e head dey touch) my sister u need get one space for our international magazine so dat dis kin message go reach out to the masses!anyways as u don talk am e reach like dat! God bless Nigeria, God bless you!

    Like

    • shughar says:

      E pain me say I no fit dey like all these comments join sef.u too get am!!!!na serious crase dey worry dem.
      Ah!space ke.lol.na God go make am possible jare.God bless u too,tnx 😀

      Like

  8. James Ndu says:

    I’ve never enjoyed any story written in pidgin English. This didn’t change that perception. I must commend the effort still. (Sentimentally)

    Like

  9. Skay says:

    M̶̲̥̅γ̲̣̣̥ sister na true U̶̲̥̅̊ jez yarn S̶̲̥̅Ơ̴̴̴̴̴̴͡ ooh, me myself i don sidon reason all dese tins, i neva still fit find reasosn why pipo d̶̲̥̅̊ε̲̣̣̣̥γ̲̣̣ do all dese kind tinz, bt anyhw sha, tank U̶̲̥̅̊ ƒό̲̣̣̣̥r̲̅ dis ♈ōϋя talk U̶̲̥̅̊ try well well ma prayer be say make safe innocent innocent pikins dem frm molosters…

    Like

  10. Anonymous says:

    Aunty U do well o

    Like

  11. muhammad says:

    In my own radical point of view, sha some get natural konji, some na devil work, some kuma na only GOD know why dem dey do this kain rubbish. My own solution be say let us fear GOD and stand up to the task and save our younger ones, because they are the society and if d society spoil every thing go turn upside down..Thank You 🙂

    Like

    • shughar says:

      My guy!!! If only ppl go gree fear God e for good.
      I like the advice when u give.na true,we all must try save our smallies them and the entire society.thank u my broda.u too much

      Like

  12. Juke says:

    Prayer’s the only cure. I swear all the prisons in the world no reach. Only prayer.

    Like

  13. elsieisy says:

    I dey like to read blogs like this wey get message wey e dey pass across, no be to just dey yarn dust. Altho dose ones dey deye entertaining sometimes. Na serious matter be this and God sef save me from ds kain matter wen I small, cos na from small my mouth dey sabi talk wetin I see sharp sharp. Make we all dey vigilant and bring depressed children closer and make our parents sef dey try create friendship btw dem and their children, fearful relationship with ur pikin go worsen matter. Lovely one Shugar 😉

    Like

    • shughar says:

      Ehen! Anoda solution don come.una don hear o.make parents dey bring dem smallie near body,especially d mama.and make me sey show love to d ones wen don already dey depressed.
      Thank u my sister!ur talk cari weight walai 😀

      Like

  14. papilo says:

    Am writing under duress …the
    write up is something everyone should take serious because its now happening at an alarming rate

    Like

  15. oris says:

    Brilliant to those bloody pedophiles out there… We need to let them know tho, I do miss ur writing, wish u wrote for a paper or magaZine.. My thoughts

    Like

  16. Anonymous says:

    Nice post but dis pikin picture na from bottomless pit o

    Like

  17. Anonymous says:

    Grt writin,impressive.

    Like

  18. Arnytah says:

    I jst tire 4 all dose useless pedophiles…wetn small pikin get wen dm dy fine..dem get special judgement o…

    Like

  19. enny says:

    Dis is terrible

    Like

  20. walecharms says:

    Na make we dey pray say make baba God dey protect our pikin dem from all dis people wey devil don build mansion gidigba for dia body.make we sef dey teach our small small pikin dem sex education right from wen den dey small. Nice write up

    Like

  21. ailizzle says:

    Nice article sister mii, ur head is dia! Omo na true yans u jus drop 4here, lotta tins dey go underG wey pple no dey hear @all… One step wey fit reduce dis kain immoral act na mke parents dey give their kids OT (orientation) nowadays, give dem awareness about all dis mata so if person warn try am wit dem or evn don try am wit dem b4, dem (d kids) go jus raise alarm on wetin dey shele… And 4d pervs n child-molestors na 2carry dem drop wit Alqaeda 4drilling cos na mental- sickness and swear dey folo dem!!! Triple twaale 4 dis post… Hailings 😀

    Like

    • shughar says:

      😀 😀 ur head dey dre gan gan my dia! I go try do d ‘liason’ with al queda sef.maybe dem go dey do well that time.lol…..tnx bruv :*

      Like

  22. Ezinna says:

    Haha.. Had to read some lines two , three times this is pidgin english made in warri *whew*.
    Awesome topic to write about, really talked abt it broadly 🙂 maybe u should start thinking of writing a book tho’ :|. Lol. God bless!

    Like

  23. warriupdate says:

    I wan salute ur courage and beta time wen u put for grand take rite dis serious mata. U see, some maga dem dey dis our area wen dem get wetin oyibo dem go call, psychological problem. If their body dey carry dem to squeeze, dem no no where ashawo qtrs dey, na small pikin dem dem con dey finger, shuk, suck etc.
    Make our pikin dem learn to shout if any maga touch their tortori, bres or brokors.

    Make u no tire, tell us more so dat we go dey wise.
    Tankyo

    Like

  24. areurmikun says:

    My sister everything u talk here na true,d mata tire me sef bt I happy say plenty pple don dey talk about am me sef write on top the mata for here
    http://tobilobaoladunjoye.wordpress.com

    Like

Kindly show a sister some love and comment..............tnx :*